BODA KAMORU, STOP TRANSPORTING FUEL IN JERRYCANS – NA HUMAN BEINGS YOU CARRY, NO BE CHRISTMAS CHICKENS
My people, make we talk true.
Your car fuel tank no be decoration.
E get design, cover, valve, and safety system.
Most cars dey carry 45 to 70 litres for tank, some SUVs even pass that one.
So tell me Boda Kamoru, why you go fill 10–30 litres fuel inside jerrycan, put am for boot or back seat, come dey drive anyhow?
Na moto you dey drive no be mobile fuel station. Abi, you wan turn your motor to mobile barbecue stand?
Now, read why this thing dey dangerous
➖ Fuel vapor dey hot pass fire. One small spark, na explosion
➖Harmattan + heat + fuel vapor= moving bomb-
one brake, one hit, one pothole, na boom
➖Jerrycan fit leak small small, you no go know until e too late
For this period wey we for de so, Yuletide, harmattan, and holiday travel:
- Roads full
- Traffic slow
- Heat high
- Emotions high
Accident fit happen anytime, ONE MISTAKE FIT WIPE PLENTY PEOPLE OUT, including you, boda Kamoru .
THIS SEASON, BE WISE
✅Use your fuel tank: na fuel dem design am for
✅ Buy fuel only when you need am
✅ If emergency must happen, no carry passengers with fuel
✅No smoke, no light, no phone near fuel
STOP AM BODA KAMORU
No turn your journey to MORTUARY!
Arrive alive. Celebrate alive.
HarmattanFireSafety
For fire and other related emergencies, contact Federal Fire Service @ 08032003557.



